Sleep paralysis don ginger paintings and horror stories. Now scientists don begin to understand why pipo dey wake up from dreams and no fit move – and why at times dem fit kontinu to hallucinate. I be teenager wen e first happun. Na for early mor-mor, some hours bifor I gatz get up from bed for school. I wake up and try to turn ova for bed, but my body no let me – I no fit move, I dey paralyse down to my toes. Although my brain dey conscious, my muscles still dey asleep. My bedroom dey hot and restrictive, e be like say di walls dey close and I come dey fear. Finally, afta about 15 seconds, di paralysis end. Later, I find one name for wetin happun to me; sleep paralysis. Surprisingly, na common night-time condition wey be say part of your brain go wake up while your body still remain temporarily paralyse. Afta dat first fearful incident, e become sometin wey dey always, wit one episode every two or three nights. Di more e dey happun, di less scary e dey become. At last e come dey littl...