flood update
Four local goments: Abua/Odual, Ahoada East, Ahoada West and Ogba Egbema Ndoni local homent areas wey dey di Orashi areas naim dey worst hit and dey suffer di flood disaster pass for Rivers State as di flood don sack many communities and schools for di areas don close down sake of di flood.
Plenti pipo don run comot from those areas as for some community flood full sotay e reach di roof of houses.
Rivers State Goment just release one billion naira to take help flood victims and set up a six-man taskforce for emergency relief measures to support di flood victims.
Comments
Post a Comment